17/12/2022
Nigeria president Muhammadu Buhari don congratulate di Moroccan football team and dia ruler, King Mohammed for making history for di World Cup in Qatar.
Nigeria presido for di congratulatory message wey im tok tok pesin Garba Shehu release today say di Atlas Lions don do well by becoming di fourth Africa to qualify for di quarter final and first to enta semi-final of di World Cup.
E say Morocco don do well to make Africa proud.
Morocco beat di likes of Germany, Spain and Portugal to reach di semi-final for Qatar.