Soccer for pidgin

Soccer for pidgin 97k followers 107 following

Osimhen!!!!!!!Goal!!Nigeria 3 - 1 Gabon Osimhen ( 102’ mins
13/11/2025

Osimhen!!!!!!!

Goal!!

Nigeria 3 - 1 Gabon

Osimhen ( 102’ mins

As e don dey official say we don qualify for African 2026 FIFA Worldcup qualifier Play-off make una get ready because we...
15/10/2025

As e don dey official say we don qualify for African 2026 FIFA Worldcup qualifier Play-off make una get ready because we don move from Mathematics to further Mathematics..

• We go dey four teams wey go play di African play-off and di teams na Nigeria, Gabon, Cameroon and Burkina Faso or DR Congo and di play-off go shele next month for Morocco..

• Any team wey win di African play-off go come qualify for another play-off wey dem dey call “ six team intercontinental play-off” .

• Dem go play di intercontinental play-off in Mexico and e go start next year March..

• Teams wey we go meet their na 🇧🇴 Bolivia, New Caledonia 🇳🇨 , two teams from Central America and one from Asia.

• Inside that Intercontinental play-off, e get wetin dem dey call Seeded teams and unseeded teams( Seeded teams na higher ranked teams in FIFA world ranking while Unseeded na lower ranked teams).

• So dem go divide two 6 teams into two groups, 3 teams per group ( 2 unseeded teams go play semi final anyone wey win go meet seeded team for final).

So di two teams wey win their group go qualify for 2026 FIFA World Cup..

But this Diego Costa sef no dey forgive and forget oo even for Charity match..Skrtel first play am f0ul , referee beg am...
11/10/2025

But this Diego Costa sef no dey forgive and forget oo even for Charity match..

Skrtel first play am f0ul , referee beg am, despite say dem beg am, Costa still do hin own back collect yellow card

After di match dem still settle sha by then Costa don do hin own back 😂

If e reach your turn wait for Karma!

No be news again say Morocco won follow co-host 2030 FIFA World Cup but problem dey..Morocco people bin dey pr0test say ...
07/10/2025

No be news again say Morocco won follow co-host 2030 FIFA World Cup but problem dey..

Morocco people bin dey pr0test say e don reach football g0vernment won run spend better m0ney build stadiums but dem dey suffer..

People wey dey organize di pr0test wey dem know as Genz 212 say Stadiums no be wetin Morocco need say na hospitals and schools dem need..

Dem dey para say di m0ney wey g0vernment won use build stadiums go reach to build/renovate plenty schools and hospitals make people for get work.

Genz 212 people dAmage many things for di protest, bUrn things before g0vernment come beg dem make dem stop say dem go look into di matter and work don start already..

No be small sontin shele for Scotland league after police turn to bodyguard take smuggle Rangers coach Russell Martin ou...
07/10/2025

No be small sontin shele for Scotland league after police turn to bodyguard take smuggle Rangers coach Russell Martin out of stadium to protect am from fans wey wan beat am. According to the tory, Rangers appoint Martin 3 months ago with the hope say him go help dem collect league from Celtic this season. But since him come na so-so draw him just dey play sotay people begin wonder say is it for okro soup abi ewedu? Out of 6 league matches Martin don draw 4, win 1 and lose 1 wey make Rangers dey 9th for table then, 9 points behind Celtic wey dem wan collect league from. Na diswan make Rangers fans give am that ultimatum say that yesterday match against relegation team Falkirk na must win and anything wey no be 3 points, make him no come out from that stadium. Match start Rangers dey win 1-0 until dying minute wey dem go allow Falkirk equalise to play another draw. Na diswan make Rangers fans gather outside some carry plank, cutlass, hammer, even 2 by 2, 4 by 4 and 10 by 10, na so dem gather outside dey wait make the coach come outside make dem use him body take check something. But police quickly suspect wetin wan happen so dem remove the coach from the team bus, put am inside special police car use escape am from the stadium. E no tay naim Rangers announce say dem don kukuma sack the coach to save am from beating because those Rangers fans can turn up anywhere and as we all know, vawulence is the name of any person, animal, place or thing and e fit occur anywhere.

My people how una see dis kind matter for Rangers so?

FT Scores: Brentford 3 - 1 Man United My people, Man Chester United don return to factory settings and all thanks to Bre...
27/09/2025

FT Scores: Brentford 3 - 1 Man United

My people, Man Chester United don return to factory settings and all thanks to Brentford wey help me flash dem for computer village..

Before match start, Man United fans no allow us hear word because dem win last weekend but as ball start everything change, I no see Man United fans online again..

Despite say Man United do shopping for Brentford dem still chop am, we dash dem penalty Bruno still miss am..

As it stands, Man United don jump down to 12th and di way Man United dey go down nowadays dey worry me and if dem continue dey go down like this dem fit discover wetin pass crUde oil..

My people abeg, tag any Man United fan wey you know help me ask am shey this life wey e dey live so dey sweet am ?

All eyes on judic!ary, so make una no panic because say PSG vs Marseille match na di same time wey Ballon D’or ceremony ...
22/09/2025

All eyes on judic!ary, so make una no panic because say PSG vs Marseille match na di same time wey Ballon D’or ceremony go start.

• Marseille vs PSG suppose play match yesterday but dem no later play am due to weather conditions, people wey dey forecast weather say better rain go fall asin those ones wey dey carry person roof commot and as e dey fall, thUnder go dey do hin own join so e better make dem play di match today.

• Some people don dey panic say this one PSG match na when Ballon d’or ceremony dey happen una sure say dem no won reap Dembele?

Make una no panic, Dembele get injUry so e no go play today that means e fit attend di Ballon d’or ceremony..

Even if others no come, Dembele go come collect hin award..

Chelsea win PSG wey dem suppose calm down their fans no gree calm down, dem come begin dey shout say dem need Barcelona ...
29/08/2025

Chelsea win PSG wey dem suppose calm down their fans no gree calm down, dem come begin dey shout say dem need Barcelona now dem don finally give dem Bayern Munich and Barcelona😂

With a little touch of Benfica,Atalanta and Napoli

I no fit wait

Tottenham behave like prodigal club today after dem squander 2-0 lead allow PSG come back beat dem 4-3 on penalties. Na ...
13/08/2025

Tottenham behave like prodigal club today after dem squander 2-0 lead allow PSG come back beat dem 4-3 on penalties. Na dem first rush PSG like indomie 2 minutes noodles score 2 goals. Dem manage defender am until the 85th minute when Lee wey just come from bench use one balabu and bulaba shot take make am 2-1. Na for injury time of injury time naim Ramos wey also come from bench use one powerful header make am 2-2 and send the match to penalties. Na during penalties naim PSG new keeper wey don first do bulaba during the match for Tottenham second goal save one penalty to help PSG win the Super Cup for the first time in their history and become the first ever French club to win the European Super Cup.

The thing wer de pain me be say PSG play Tottenham comeback in both penalty and normal match those werey still no win match

My people how una see this match wey shele tonight so?

🚨 𝐎𝐅𝐅𝐈𝐂𝐈𝐀𝐋: Donnarumma says his 𝒈𝒐𝒐𝒅𝒃𝒚𝒆 to PSG as “𝐬𝐨𝐦𝐞𝐨𝐧𝐞 𝐰𝐚𝐧𝐭𝐞𝐝 𝐦𝐞 𝐨𝐮𝐭” 🤯💔“To the special Paris fans,From the first da...
12/08/2025

🚨 𝐎𝐅𝐅𝐈𝐂𝐈𝐀𝐋: Donnarumma says his 𝒈𝒐𝒐𝒅𝒃𝒚𝒆 to PSG as “𝐬𝐨𝐦𝐞𝐨𝐧𝐞 𝐰𝐚𝐧𝐭𝐞𝐝 𝐦𝐞 𝐨𝐮𝐭” 🤯💔

“To the special Paris fans,

From the first day I arrived, I gave everything – on and off the pitch – to earn my place and defend the goal of Paris Saint-Germain.

Unfortunately, someone decided that I can no longer be part of the group and contribute to the team’s success. 𝐈 𝐚𝐦 𝐝𝐢𝐬𝐚𝐩𝐩𝐨𝐢𝐧𝐭𝐞𝐝 𝐚𝐧𝐝 𝐝𝐢𝐬𝐡𝐞𝐚𝐫𝐭𝐞𝐧𝐞𝐝.

I hope to have the opportunity to look the fans at the Parc des Princes in the eyes one more time and say goodbye as it should be done.

If that doesn’t happen, I want you to know that your support and affection mean the world to me, and I will never forget it.

I will always carry with me the memory of all emotions, the magical nights, of you, who made me feel at home.

To my teammates, second family, thank you for every battle, every laugh, every moment we shared. You will always be my brothers.

Playing for this club and living in this city has been an immense honour. Thank you, Paris. 💙❤️

I say may I copy paste today

Address

Calabar

Website

Alerts

Be the first to know and let us send you an email when Soccer for pidgin posts news and promotions. Your email address will not be used for any other purpose, and you can unsubscribe at any time.

Share

Category